My Simple Tricks to Stay Cool
The heat these days in Nigeria no be small thing at all. Sometimes I just dey wonder if the sun is angry with us or if we offend am. Even early in the morning when I wake up, everywhere already hot. And by afternoon, body go dey pepper you like say you dey fry inside pot of oil. Honestly, the heat don make me change many things in my daily routine just to feel normal.
First of all, I try to bath like 2 times daily. I no fit lie. If I no bath at least twice, my body no dey rest. Even at night, sleep no dey come easy if I no cool body before going to bed. I now use small bowl of water to wash face and feet before bed sometimes. E dey help small.
Another thing wey I do be say I drink plenty water. I now carry bottle water every where I go. I sabi drink like 5–6 sachets of pure water daily, sometimes more. E dey help me stay cool and avoid dehydration. I also started taking fruits wey get plenty water like watermelon, cucumber and oranges. This fruit no be only sweet but e dey cool body.
I also dey reduce how I waka around under sun. If I no get serious reason to go outside, I dey stay indoors. And if I must go out, I go find umbrella or wear big hat. I even dey use handkerchief to clean sweat anyhow. E dey embarrassing when everywhere you enter, na sweat be the first thing people notice.
For house, I try to keep windows open for cross breeze. Sometimes I soak small towel inside cold water and use am to clean my body. When light dey, na fan I dey on full blast. Generator fuel cost, so I dey use fan wisely. I still dey find way to buy rechargeable fan, because this heat no get part two.
Clothes too matter. I don pack my heavy clothes one side. Na light cotton dresses, shorts and easy tops I dey wear now. Sometimes I go wear wrapper and singlet for house just to make breeze enter well.
I won’t lie, this weather don humble me. But I dey try manage and adjust. I sabi many people dey suffer worse, especially people wey dey sell for road under sun. May God help us all.
At the end, I don learn say in this hot season, na how you take plan yourself go determine how you go survive. I try keep my mind calm, drink water, stay clean and thank God every day.
So my people, how una dey cope with this wicked heat?
Thanks for stopping by and reading my post
With Love❤️🩷🧡
Congratulations @royaluy! You have completed the following achievement on the Hive blockchain And have been rewarded with New badge(s)
Your next target is to reach 200 replies.
Your next payout target is 100 HP.
The unit is Hive Power equivalent because post and comment rewards can be split into HP and HBD
You can view your badges on your board and compare yourself to others in the Ranking
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word
STOP
They're indeed simple but actually great ideas
This post has been manually curated by @bhattg from Indiaunited community. Join us on our Discord Server.
Do you know that you can earn a passive income by delegating to @indiaunited. We share more than 100 % of the curation rewards with the delegators in the form of IUC tokens. HP delegators and IUC token holders also get upto 20% additional vote weight.
Here are some handy links for delegations: 100HP, 250HP, 500HP, 1000HP.
100% of the rewards from this comment goes to the curator for their manual curation efforts. Please encourage the curator @bhattg by upvoting this comment and support the community by voting the posts made by @indiaunited.
[@PowerPaul:]
Hey Opemipo! Because of your participation in the CryptoCompany community and your participation in the "Banner for Boost" campaign you received a vote from @CryptoCompany and its trail! Hive a great day!
Which heat? Because it's very cold in Lagos